Popular Posts

Saturday 9 August 2014

Atletico Madrid don carry Jesus Gamez

Atletico Madrid don agree to sign de Spanish right back wey sabi football well well, Jesus Gamez wey come from Malaga for three-year kontrat wey go hapun wen dey don finish hin medical test, naso de La Liga champions yarn for Friday.

Gamez wey don spend all hin career for Malaga go cover de fullback for Juanfran and Jose Luis Perez Caminero wey be sporting director don tok say de 29-year-old also fit tap ball for central defence if de club want am so.

“Gamez be fullback wey sabi football well well wey go surport our defence and make competition to increase for inside de group”, naso Perez Caminero tok for Atletic website ( www.clubatleticodemadrid.com) .

De club also yarn say dem don agree to loan French midfielder Josuha Guilavogui to Bundesliga club ViL Wolfsburg for de ness two seasons.

Atletico go begin dia La Liga title defence for August 25 against city rivals Rayo-Vallecano, dey go play de fess leg for de Spanish Super Cup against Real Madrid for August 19 as de return leg against de Calderon for August 22.

No comments:

Post a Comment