Borussia Dortmund don suffa double injury wahala days befor
Bundesliga season go begin as midfielder Oliver Kirch don komot for two months
and Ji Dong-won go miss for almos four weeks, naso de club yarn for Wednesday.
Lass season’s Bundesliga runners-up wey go open dia campaign
against Bayer Leverkusen for Saturday, go miss Kirch for at least eight weeks
with thigh muscle wahala as de statement get am.
Hin South Korea teammate, wey join from Augsburg dis season
go also waka for about four weeks as thigh muscle tear don knack am down.
De two playas bin get injury for de training wey shele for
Tuesday afternoon and kon go Dortmund hospital for check for Wednesday, na de
hospital wey confirm dia injuries.
Dortmund also go compete for de Champions League wey go
begin for September.
Dis na big gbege for Dortmund wey go put leg for de same
nicker with Bundesliga powerhouse Bayern Munich for de German league title as
de season go open for Friday.
De two ogbonge clubs don support dia squard well well with
key transfers and na de two clubs dey reign for Germany as dem don give other
clubs big gap.
For de Bavarians, dey no dey see am like say e go dey easy
like lass season wen carry de Bundesliga crown for March wey be time dey record
am.
“Dis season we go need some time”, naso coachi Pep Guardiola
tok lass week. “For now i get only eight or nine playas wey dey kampe”.
No comments:
Post a Comment